You are viewing a single comment's thread from:

RE: Contest: Handling Accusations and Rumours.

in Steem4Nigeria2 days ago

Omo i will like use pidgin in this case...

Let’s be honest, for where I come from, accusations and false rumours na like breakfast — anybody fit chop am, anytime. One minute you’re minding your business, next thing you hear, “I hear say na him…” and boom! Your name don enter WhatsApp groups you didn’t even join 😂.

Accusations? That one na when person go look you finish and still say, “I know say na you do am.” No evidence, nothing. Just vibes and suspicion. Sometimes e go even be your neighbor wey greet you with smile wey carry hidden agenda.

False rumours? Na the advanced version. This one na premium gossip. Imagine say you dey house, person dey tell another person your full life history — and even you go shock because you never hear that version before. Politicians na king of this game. They will just manufacture stories like factory, make the public begin doubt who dey tell the truth.

But wetin I don learn be say, truth no dey make noise. E dey walk slow but steady. So even when people accuse you or carry your gist like gala, just calm down. No go fight for junction — allow time expose the real movie.

No be every "I hear say" you suppose believe. Some na audio lie — no video, no evidence 😂. Before you join to spread gist, ask yourself, “If na me dem dey talk about, I go like am?”

I rest my case.